Dem bin exhume 13 bodies and 18 body parts from shallow graves near di Shakahola forest for di coastal region for Kenya on Monday 25 August.
Di exhumation process wey dey happun for Kwa Binzaro Village begin last week afta many children don miss.
Na so dem begin to chook fresh eye for di mata.
E neva dey clear at dis time if di disappearance and di death dey connected to di case wia one pastor don make im followers starve to death inside di forest as part of rituals.
For one of di worst cases of cult-related mass deaths for di kontri, dem bin find more than 400 bodies for 2023 for di Shakahola forest wey dem believe say na followers of di pastor wey don allegedly encourage dem to starve to death.
Dis fresh bodies wey dem bin dey exhume na afta one order for July when di children don miss, wey im trigger investigation.
Prosecutors tok say dem don arrest 11 pipo wey dey connected to dis case - three of dis pipo na followers of pastor Paul Mackenzie at di time of di "Shakahola Forest Massacre"
Mr Mackenzie wey dem arrest last year and bin plead not guilty to manslaughter, allegedly tok im followers say dem gat to stop eating if dem want to reach heaven fast fast.
Im and 29 co-accused pipo currently dey on trial.
AFP news agency bin report say one court for Mombasa bin adjourn di ongoing case early dis month wey dem tok say dem find fresh evidence.
Read more here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2kz7q8nyjlo
0 Comments